Wetin you go do if person dey threaten to share ya intimate pictures?

Create Ya Case

You no dey alone

You dey fear say person fit share ya private pictures for online? Shey e don already happen to you?

We dey hia to help

How StopNCII dey Work?

Dem start Revenge Porn Helpline (RPH) for 2015, and since then, dem don help plenty people wey dem share their nakedness without their permission.

Wetin be StopNCII.org?

StopNCII.org na free tool wey dem design to help people wey dey suffer because dem share their naked picture or video (NCII) without their permission.

Di tool dey work by generating hash from ya intimate picture(s)/video(s). StopNCII.org go then share di hash with companies wey dey work with dem so dat dem fit help find and comot di pictures wey dem dey share online. Learn more about di tool and companies wey dey work with dem.

Image hashing na way to use computer trick assign one special code wey dey different for every picture. All di copy-copy of di picture get di same kain of hash value. Na why some people dey call am 'digital fingerprint' sometimes.

If you wan know more, abeg waka go di ‘How e dey Work’ page.

With removal rate over 90%, RPH don dey remove over 300,000 intimate pictures for people wey dem share their nakedness without their permission from internet.

StopNCII.org na Revenge Porn Helpline dey run am wey be part of SWGfL. SWGfL na charity organization wey no dey look for profit, and dem sabi dem well-well for di whole world. Dem work na to make sure say everybody dey benefit from technology without wahala. SWGfL wey dem start for 2000, dey work with plenty partners dem and stakeholders dem for all over di world to protect everybody online.

Revenge Porn Helpline (RPH) — wey dem start for 2015 — don help thousands of people wey dey suffer because dem share their naked picture without their permission./p>

No forget say, everything you dey feel, e dey valid. Dem dey suffer you.

We dey protect ya personal life

Di tool dey work by creating hashes dem (digital fingerprints dem) of di pictures dem wey you select, direct for ya phone. Na only dis hash (fingerprint) we dey share with StopNCII.org, and companies wey dey work with dem. To protect ya privacy, StopNCII.org no dey download picture from ya phone and dem dey collect only small data wey dem need to run di service.

Read we privacy policy

Who StopNCII.org dey helep?

If you dey meet these criteria wey dey ground, you fit use StopNCII.org.  

You be:

  • Di person wey dey inside di picture? (Why we dey ask dis one?)
  • You be 18 years or older when dem snap di picture?
  • Be over 18 years old now? (Why we dey ask dis one?)
  • You still get di picture or video? You dey naked, half-naked, or you dey do sexual things for inside di picture/video?

If all these things apply to you, and you don ready to use di StopNCII tool. Click on ‘Create Ya Case’.

If you no meet all di things wey dem talk, no worry, you fit still get help. Click hia for more informate