FAQ

  • Wetin be non-consensual intimate image sharing (NCII) sef?

    NCII na when person share intimate picture or video of anoda person, for internet or outside, without dem permission. E fit include picture wey dem don change/deepfakes.

  • Wetin you mean by 'intimate'?

    Intimate pictures dey be pictures and videos of people wey naked, or wear pant, wey dey show dem private parts dem, dey do sexual things or dey pose anyhow for sexual way. You fit learn more about intimate image abuse here.

  • E dey against law to share person intimate picture without di person allow?

    NCII dey get recognition more and more as crime for different parts of di world. You fit wan holla person wey sabi law, so dem fit advise you https://revengepornhelpline.org.uk/how-can-we-help/if-we-can-t-help-who-can/help-for-victims-outside-the-uk/.

  • Who be di people wey dey suffer from intimate picture abuse?

    Any adult fit be victim of intimate image abuse, no matter whether na man or woman, and who dem choose to dey with. If di picture be of person dey under 18 years – even if na you wey don old pass 18 years now – abeg, submit am to TakeItDown.

  • Wetin go happen if person dey threaten to share my pictures, or I dey fear say dem fit share my pictures?

    We dey advise say make you open case for StopNCII.org so dem fit protect ya pictures, and make you find people for around wey fit advice and help you.

  • Wetin go happen if person dey with me for inside di pictures wey I wan submit?

    No matter who dey inside di picture, if dem share ya intimate picture wey you no gree, that one na NCII and you fit hash dis picture.

  • Wetin go happen if person don already share my intimate pictures online?

    If dem don already share ya intimate pictures for internet, di first thing you suppose do be to report dem to di platforms. You fit still add dem to StopNCII.org for future protection.

  • My question no dey hia; I fit contact StopNCII.org?

    If we never answer ya question, abeg sharply send we team message for stopncii@swgfl.org.uk, we go try put am for we FAQs for future. We no fit recover any case number, PIN, or comot any hashes dem, and any request wey concern dis matter, we no go answer am.

    Know say dis email no be for support, so e no fit offer any additional help to comot or report anything. If you feel say you need extra help, check we support page.

  • How StopNCII.org dey work?

    Di tools dey work by creating hash from ya kain intimate picture(s)/video(s). Image hashing na way to use computer trick assign one special code to one picture. All di copy-copy of di picture get di same kain of hash value. Na why dem dey sometimes call am 'digital fingerprint'. StopNCII.org go share di hash with di companies wey dey cooperate, so dat dem fit help find and comot di pictures wey dey circulate online.

  • How di digital fingerprint dey work?

    Digital fingerprint – or hash as dem dey call am – be like barcode wey dem dey attach to picture/video when dem put am through we technology. Dem go then save di hash for inside StopNCII.org bankt, den share am with platform wey dey work with us. Dem go dey compare those hashes dem to every picture wey dem upload for partner platform. If e match, dem go comot di picture. Algorithms dem wey we dey use be PDQ/PhotoDNA for pictures dem, and MD5 for videos dem. Dem dey open-source and na industry standard for apps like we own.

  • How I go know say dem don accept my hash?

    You fit check ya case for dashboard to see how far, where you go see if dem don block di picture. You fit need wait like 3 to 5 days before you go see any updates dem.

  • Wetin dey happen to my hash once dem don put am for di bank?

    Once you don create ya hash finish, and you don submit am to StopNCII.org bank, dem go send am go all di companies wey dey participate for di program. If pesin try upload picture wey dey same, di platforms dem go check di content to see if e dey break dia rules, den dem go do wetin dem suppose do. Dem go dey share di hashes dem with new partners as dem dey join StopNCII.org.

  • Person go fit see my pictures?

    Nobody else go see ya pictures when dem create di hash, di pictures no go comot from ya device. If person wan upload picture wey resemble anoda one for any of we companies wey dey participate, dem go check am wella to see if e dey break their rules, then dem go do wetin dem suppose do.

  • Wetin go happen if I lose my PIN or login?

    Bad news be say, you no fit get am back at all, so abeg, keep dis informate safe. If you lose ya case number or PIN, you no go fit check ya case status or withdraw ya hashes dem. We no fit help you reset ya PIN or find ya case number, because we no dey keep dat kain informate. When you dey submit, you fit choose make dem send ya case number to you through email wey system generate. For ya privacy and safety, we no go keep ya email address if you do dis one.

  • Why I no fit create account using my email address?

    We dey try make sure say you no need to share too much data, so we no dey ask for, or keep ya email address before you fit create case. All you need do na to hash ya pictures and hold tight to ya PIN and case number. Like dis, we go dey keep small-small personal informate (only wetin we need to run dis service), na im we dey keep.

  • Wetin be di things wey dis technology no fit do?

    StopNCII.org dey use strong technology wey dey match pictures, tech companies don dey use am to detect exact matches dem of content wey dem don share before, make dem no fit reshare them, so as to prevent wahala for their platforms dem. If dem crop picture wey dem don hash before, add filter, or cut video short, di original hash fit no recognize di picture again. We go need hash di new picture different.

  • Which format/file size my pictures suppose be?

    Pictures and videos suppose dey inside jpeg, jpg, png, gif, psd, tiff, xcf, tga, miff, ico, dcm, xpm, pcx, bmp, mp4, mov, avi, qt and wmv. Videos wey big fit need small editing make dem size reduce and dem go need different-different hash. Di maximum number of hash wey you fit upload one time na 20, sake of say we no wan make e too hard for each device to process.

  • My hash no gree succeed create – why?

    Some reasons why ya hash fit fail include: Maybe ya picture no be di correct format. If you try submit video, di file size fit too big for ya browser to handle di process. Or, e fit be say na technical problem: abeg send any error wey you see to stopncii@swgfl.org.uk

  • I fit submit screenshots dem?

    Di original picture go work best, but if na screenshot you get, you fit use am. Before you submit am, just remember to comot anything wey dey round di picture (example borders) without cutting di picture imself.

  • Di video hash go cover thumbnail too?

    Videos and pictures dey use different hash formats dem, because every video dey get picture thumbnail with am. We dey advise make you snap some screenshots of di video, come hash di pictures together with di video.

  • StopNCII.org go keep my original picture/video?

    No. ya pictures no go ever commot from ya device, and we no go save am. Na only di digital fingerprints dem we go keep, wey dem dey call hashes dem. We partners go only see di hashes so dem fit match am with pictures wey people upload to their platform.

  • How long e dey take before dem protect my pictures?

    Dem go create ya hash sharp-sharp, if e match, di platforms dem go moderate di content.

  • I fit add more pictures to my case?

    No. You go need start new case.

  • I must keep di intimate picture for my phone forever?

    No. Once dem don create di hash, you fit delete di picture from ya phone if you want, di hash go still dey. Like permanent fingerprint, e go still find di picture if dem don match am for platforms dem wey dey participate.

  • Wetin about 'deepfake' or fake pictures wey dem create?

    If na you dem use do 'deepfake' or fake picture, and you get di picture, and di picture show you naked or half naked, then you fit hash am. We dey include these pictures inside wetin NCII mean.

  • Dem dey do sextortion/webcam blackmail for me, I fit use StopNCII?

    Yes, if you fit see di content, you fit create case; if na screenshot only you get, crop dem as you fit. But, dis one no mean say dem no fit share video o.

  • If my mind change, I fit withdraw my hashes dem from StopNCII.org?

    Yes, you fit withdraw ya case anytime. Go ya Case Status page, then select di 'Withdraw' button. To see ya Case Status, you go need ya case number and PIN wey you create when you submit di case. If you click Withdraw, e go comot di whole case. Even though you fit withdraw, remember say companies wey dey participate get right to continue to enforce their rules once dem don sabi di hash.

  • I fit see how di tool dey work?

  • Which platforms dey use dis technology now to protect my picture?

    You fit see people wey dey participate now hia. We dey always find more partners to join us.

  • Which informate StopNCII dey keep?

    StopNCII no dey keep any data, na only di hashes dem dey keep. We no dey keep or store any personal data, so e dey important to keep ya PIN and Case Number safe. If you want know more, check we privacy policy hiae.

  • Dem dey cover pictures wey dey touch culture?

    We fit only collect hashes dem wey follow di rules wey we talk about for up. But we know say oda kind pictures fit cause wahala: abeg check Resources and Support for more informate or yarn one of we partners for ya own kontri, dem go fit help you more, more informate dey hia.

  • StopNCII.org dey cover encrypted services dem?

    No. StopNCII.org dey only work for platforms wey everybody fit see post, stories and videos dem, and so on. Many messaging apps dey use encryption, so hashing no fit work for dem.

  • StopNCII.org dey stop intimate pictures from spreading for di whole internet like that?

    No, StopNCII.org dey work only with platforms wey dey we partners page. We dey always look for more online platforms to work with, so StopNCII.org fit reach more places.

  • I suppose send di original picture and di one wey dem edit?

    Only submit di picture wey you want make dem comot from we partner platforms dem - for example, if na edit picture you want make dem comot, abeg just submit that one.

  • I need yarn person about wetin happen and how body dey do me, how I fit get help?

    You fit see services wey dey offer help for hia.

  • Dem don share my content already, wetin I fit do?

    If dem don already share ya intimate pictures for internet, di first thing you suppose do be to report dem to di platforms. You fit still add dem to StopNCII.org for future protection.

  • Who fit use dis service?

    You gats meet these criteria so that you fit use dis tool:

    • If di picture be you own and you fit access am.
    • If di picture na intimate one (show you naked or show sexual things).
    • If you don pass 18 years for inside di picture.
  • I fit submit pictures for anoda person?

    No you no fit. We fit only collect hashes dem from you if na you dey inside di content. Abeg, try tell di person wey dey inside di picture (if you sabi dem) make dem start di process by demself, or if dem dey struggle with di process, make dem holla any of di support services wey dey listed hia https://stopncii.org/partners/global-network-of-partners/ for more support.

  • Must I dey inside UK before I fit use di tool?

    No, you fit dey anywhere for di world.

  • I dey under 18, why I no fit use StopNCII.org?

    Di law wey dey guide naked or sexual pictures of children different from that of adults for most part of di world. Because of dis one, if you dey under 18 for inside di pictures and videos, you fit get help from TakeItDown. Abeg check Resources and Support for more informate.

  • Who be SWGfL?

    SWGfL (www.swgfl.org.uk) na charity organization, wey sabi work well-well for international level, to make sure say everybody fit enjoy technology without wahala. Dis charity don dey for over 22 years, e dey responsible for services wey win award, resources and campaigns dem and dem dey operate three Helplines wey dey help different kind of people dem wey get online wahala. Dem dey work with different Government people both for Naija and oyibo land, and dem don talk for big meetings for Europe, America, Asia, and Africa. SWGfL, with Childnet and Internet Watch Foundation, dey lead UK Safer Internet Centre.

  • StopNCII.org na government work?

    StopNCII.org na tool wey Meta and non-profit charity, SWGfL develope. Di tool no join hand with any Government body, na only social media platforms and NGOs dem wey dey we network we dey work with.

  • StopNCII.org dey carry person or wetin dem do give police?

    StopNCII.org no dey work with police to report content, but we global network of partners fit dey your side to support you take more action, if you want.