How StopNCII.org dey Work
Step 1
Choose any intimate picture(s)/ video(s) wey dey ya phone.
Step 2
StopNCII.org go make hash (dey also call am digital fingerprint) of di picture(s)/video(s) wey dey ya phone. Dem go send only di hash from ya phone, but dem no go send di picture/video imself. We no go share ya content, e go remain inside ya phone.
Step 3
If dem succeed create ya case, you go receive case number wey you go use check how far ya case don go: no forget to write down ya case number and PIN so you fit reach ya case after you don submit am. If you lose am, you no fit recover am so make sure say you keep am safe.
Step 4
Di platforms wey dey participate go dey look for pictures wey match di hash, and dem go comot any picture wey match from their system if e dey against their policy ontop intimate picture abuse. Abeg note: StopNCII.org no fit comot pictures dem from di whole internet, na only di platform dem wey dey we partners page we dey work with.
Step 5
StopNCII.org go dey check time to time for matches dem for platforms wey dey participate.
Step 6
You fit use ya case number check how ya case dey go anytime, or you fit withdraw am.
Question? See we FAQ Page