About Us

StopNCII.org dey run through di Revenge Porn Helpline wey be part of SWGfL, na charity organization wey no dey look for profit wey believe say everybody suppose dey benefit from technology without wahala. SWGfL wey dem start for 2000, dey work with plenty partners dem and stakeholders dem for all over di world to protect everybody online.

StopNCII.org don bring new technology wey tech and big companies dem dey use to protect people make dem no dey share their intimate pictures for online. Dis brand new tool dey give any adult wey dis abuse fit affect, chance to protect themselves, so dem go dey gidigba when dem enter internet.

Revenge Porn HelplineSWGfL - Safe, Secure, Online

Revenge Porn Helpline (RPH) start work for 2015, dem dey help people wey dey suffer from their intimate pictures wey dem share without their permission (NCII). Since dem create am, di Revenge Porn Helpline don support thousands of people wey be victims With removal rate wey pass 90%, dem don succeed remove more than 300,000 pictures wey people share without permission from di internet.

For organizations dem wey get interest to join body with, or to support StopNCII.org, abeg holla us.